Serap sue CCB to publish properties of Nigeria Govnors, Presidents since 1999

President Muhammadu Buhari dey receive asset declaration form from Chairman of di Code of Conduct Bureau (CCB), Prof. Muhammad Isa for State House, Abuja on May 27, 2019

Wia dis foto come from, @BashirAhmaad/Twitter

Wetin we call dis foto, President Muhammadu Buhari dey receive asset declaration form from Chairman of di Code of Conduct Bureau (CCB), Prof. Muhammad Isa for State House, Abuja on May 27, 2019
Read am in 2 mins

Civil society group, Serap on Sunday drag Nigeria special office wey dey shook eye for property of politicians go Lagos High Court.

Socio-Economic Rights and Accountability Project want di court to force di Code of Conduct Bureau to publish di properties of pipo wey don be Govnors and Presidents since 1999.

Di group argument wey dem cari go court na say di Code of Conduct Bureau no get reasonable grounds to deny SERAP di Freedom of Information 'FOI request', as e dey in di interest of justice, di Nigerian pipo, openess and to dey accountable to publish full informate of di wealth wey presidents & state govnors get since di return of democracy in 1999.

Three reasons why Serap dey challenge Nigeria Code of Conduct Bureau

1. Freedom of Information Act

Serap say even tho say constitution no make am by-force for public officers to declare dia assets, di Freedom of Information Act 2011 don provide method for di Code of Conduct Bureau (CCB) to make sure say magomago no dey di asset declarations by public officers wey dem elect.

2. Fake declaration - corruption accuse

Di group also argue say as na say na fake declaration of dia assets na wetin make plenti public officers dey face corruption accuse or dey guilty of corruption, di CCB no suppose dey allow politicians dey yeye di asset declarations provisions of di constitution by allowing dem to continue to dey take advantage of di comma wey dey legal processes for dia own illegal benefit.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

3. Quality of public discussion

Di quality of public discussion go drop well-well if CCB no dey provide information from public authorities, and to guarantee freedom to tok witout di need to add di right to know go be formal exercise, Serap add.

No be today di group don begin shook mouth on top mata wey concern goment and openness ontop goment wealth and how politicians dey use or spend goment money.

Serap bin shook mouth make Bayelsa State goment drop life pension for lawmakers, and e be like say dat one work as las las di govnor no gree sign di law.

Na dem be one of di civil society groups wey boldly come out to demand say make Nigeria President Muhammadu Buhari investigate one powerful govnor for northern Nigeria if im dey truly fight corruption. Dem say say Buhari must investigate Govnor Ganduje video wey show am dey put money insie babariga if im dey fight corruption.

Di Socio-Economic Rights and Accountability Project don also sue govnor Okowa for poor education standard inside Delta state, southern Nigeria. Dem para say di condition of primary schools all ova Delta state for Nigeria suggest say goment don abandon poor children.

But many of di court cases wen dem don file so far, neva get head.