Apapa Lagos Traffic: Govnor Babajide Sanwo-Olu make 'U-turn' say im no promise to clear di area in 60 days

Wia dis foto come from, Other
Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu make U-turn tok say im no ever promise to solve di Apapa go-slow wey dey cause traffic palava in 60 days.
"I never promise to clear di traffic congestion in 60 days instead, I say I go review wetin don happun for Apapa roads in 60 days." Na wetin Sanwo-Olu yan as im dey ansa questions from tori pipo for Aso Rock, Abuja on Tuesday.
But BBC News Pidgin don confam say di govnor bin true-true promise to end Apapa traffic, during im election campaign.
For dis video during di Lagos Chamber of Commerce govnorship debate, e make di promise.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
Sanwo-Olu again tok di mata during di Lagos Govnorship debate for for January 2019 just weeks to im election as govnor.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
As at Wednesday morning wen BBC Pidgin tori pesin visit di area, agbero still dey around di Oshodi - Apapa highway dey extort money from truck drivers even if say di Presidential Task Force wey dey clear traffic for di area dey dia.One of di truck drivers secretly confirmed to we tori pesin wey even cari korokoro eye see one case of kparakpo.
Traffic for Apapa area of Lagos na big palava wey dey affect business and movement of pipo and di Apapa road na im lead to di busiest sea port wey dey Lagos wia most of di good ad service dem dey enta Nigeria.
Only days ago, long 40 ft containers fall off from trailer ontop cars wey hook for di go-slow sake of di bad condition of di road.
End of Di one wey oda users dey read well well
Tori be say at di moment di presidential taskforce dey realy try dia best as di traffic to long like di way e bin bad before.

Wia dis foto come from, Babajide Sanwo-Olu/Facebook
According to Sanwo-Olu first promise for May 2019, "Di Apapa trailer issue; na campaign issue, e dey very serious. I go take am very seriously. I believe say na something wey we go solve in di first 60 days of our government. Whatever e go cost us, we go take dem out.
But all dat one change on Tuesday afta Govnor Sanwo-Olu attend APC Govnors Forum meeting wit President Buhari for Aso Rock, e say di only solution na to get anoda port to reduce di whole activities wey dey happun for Apapa area.

Wia dis foto come from, Twitter/@jidesanwoolu
Tori be say Sanwo-Olu, wen e still be govnor-elect on May 18, 2019 for one interactive session wit im classmates on di Executive Master of Business Administration class, University of Lagos, 1998/2000 set, say im go end di long go-slow for Apapa area of Lagos within di first 60 days of im goment.
He say not minding di politics wey dey involve, im go clear di area of all di trailers wey dia operations dey responsible for di kain go slow wey dey tie wrapper for di area.
BBC Pidgin also find out say for May 2019 wen di Govnor bin use clear eye make di promise again to clear Apapa traffic in 60 day
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4
Meanwhile, Nigerian goment on Friday extend di deadline for di Presidential Taskforce to clear di traffic wey dey always cross leg hold walking stick for Apapa area of Lagos.
Na two extra weeks na im Federal Goment give di task force to settle di matter afta members of di taskforce and oda stakeholders bin submit request.
Vice President Yemi Osinbajo approve di extension for one meeting of di Presidential Taskforce wit stakeholders wey happun for Presidential Villa, earlier in di week, according to press release wey BBC Pidgin cari eye see.
Di taskforce wey start dia assignment on May 24, go now present dia formal report by June 24.