Sudan security forces fire protesters tear-gas

Wia dis foto come from, Ken Jack
Security forces for Sudan don fire tear gas and bullets to scata I-no-go-gree pipo wey dey try protest for Khartoum.
At least one pesin die for di northern district of Bahari according to doctors wey dey work wit di opposition.
Dis wan dey come as join bodi wey dey lead Sudan pro-democracy movement don call for nationwide protest some days afta plenti pipo die inside military attack for di kontri.
Dem want make di I-no-go-gree start on Sunday and continue until civilian goment come back to power.
Di group make dis announcement afta goment arrest three opposition leaders wey do tok-tok wit Ethiopia Prime Minister Abiy Ahmed to try arrange meeting for peace to reign.
Di main protest group also tok say dem don arrest some workers for di kontri bank, airport and di electricity company.

Wia dis foto come from, Reuters
Di Sudanese Professionals Association (SPA) also tok say authorities dey threaten di employees say make dem go work and make dem no go strike.
Di ruling Transitional Military Council (TMC) no make any comment.
End of Di one wey oda users dey read well well
Sudan goment arrest opposition politician Mohamed Ahmed on Friday, early on Saturday dem arrest rebel leader of di SPLM-M group Ismail Jalab and im tok tok pesin Mubarak Ardol.
Protest leaders say dem no go fit tok wit di Transitional Military Council sake of dem no go fit trust dem again afta di bloodshed.

Di Transitional Military Council begin dey run tins afta I-no-go-gree make dem comot long time President Omar al-Bashir for April.
Di military bin promise to handover to civilian rule but on Monday, plenty pipo die afta dem use strong hand and pepper eye take scata pipo wey dey protest for Khartoum.












