Nigeria President Muhammadu Buhari dey host Ghana President Nana Akufo-Addo for Aso Rock

Wia dis foto come from, Other
Nigeria President Muhammadu Buhari on Wednesday afternoon host Ghana President Nana Akufo-Addo for Aso Rock, Abuja.
E neva clear, wetin di two leaders meeting dey all about.

Wia dis foto come from, Bahsir Amad
Di meeting dey happun just three days afta di President return to Abuja from Saudi Arabia wia e attend di number fourteen meeting of Organisation of Islamic Cooperation (OIC).
According to presidential tok-tok pesin, President Nana Akufo-Addo go pay courtesy call visit to oga Buhari.
We go give una more details later...







