Sudan forces wan use pawa pursue protesters

Wia dis foto come from, Getty Images
Security forces for Sudan take force enta di site of protesters for central Khartoum early mor-mor on Monday.
Pipo wey see as e happun tell Arab television say di security forces shoot gun and activists say dis na attempt to scata di protest outside di Defence Ministry.
Medical sources say at least eight pipo don die, but di Transitional Military Council (TMC) wey dey incharge since President Omar al-Bashir comot for April, say dem no use force to break up di main protest site.
But for statement, di main protest group say "di protesters wey siddon for front of di army general command dey face serious kasala as dem wan pursue dem." Di group say make Sudan pipo come to dia rescue.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di Sudanese military bin comot President Omar al-Bashir for April afta months of protests because of im 30 years for office.
But thousands of protesters still camp outside di Defence Ministry, dey demand make military rulers wey replace Bashir hand over power to civilians.








