Presidential Election Tribunal don begin sitting for Atiku petition against Buhari

Venue of di 2019 Presidential Election Petition Tribunal Pre Hearing at di Court of Appeal, Abuja.

Wia dis foto come from, PDP

Read am in 1 mins

Presidential Election Tribunal don begin sitting for Nigeria main opposition candidate Atiku Abubakar petition against President Muhammadu Buhari victory for di February 23, 2019 vote.

Atiku Abubakar petition before di Presidential Election Petition Tribunal na say di ruling APC party use mago mago win di election and say na im be di real winner.

Na for Court of Appeal, Abuja di tribunal sitting dey take place.

Tori be say na Justice Zainab Bulkachuwa and four oda Justices be members of di 2019 Presidential Election Petition Tribunal.

Di odas include; Justice Abdul Aboki, Justice Peter Ige, Justice Joseph Ikyegh and Justice Samuel Oseji.

Nigeria main opposition PDP post video of di sitting wia Justice Bulkachuwa say e pass 700 petitions from all ova di kontri wey don land di tribunal table.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

More details go land later...