Tiwa Savage don sign ogbonge deal with Universal Music Group

Tiwa Savage

Wia dis foto come from, Universal Music Group

Read am in 1 mins

Ogbonge Nigerian singer and songwriter Tiwa Savage don sign exclusive global recording deal deal with Universal Music Group (UMG).

Tiwa na one of Africa biggest star and artist wey don make wave for di music and entertainment industry.

Under di agreement, UMG na im go dey release her future music internationally for more dan 60 kontries worldwide.

Efe Ogbeni of Regime Music Societe and Vannessa Amadi-Ogbonna na im go dey produce her projects.

Tiwa Savage

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, Tiwa Savage and her new UMG family

Tiwa Savage don chop plenti accolades including di Best African Act by the MTV European Music Awards wey she be di first female wey go ever collect di accolade.

According to Tiwa, dis tin, sweet her well-well for bell.

"My biggest goal na to make Africa proud. I dey very excited and i dey grateful to Sir Lucian Grainge and my new UMG family." Na so Tiwa tok.

Meanwhile her former record label for Nigeria Mavin Records, don congratulate her with announcement ontop Instagram.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Tiwa Savage don release plenty hits including 'Mr Lova Lova' ft Duncan Mighty, 'Diet' and 'Tiwa's Vibe' all wey hit di No. 1 spot for charts across Africa.