Zainab Aliyu land prison for Saudi Arabia ontop drug crime wey she no commit

Wia dis foto come from, Hajara Habib
Students of di Yusuf Maitama Sule University for Kano North West Nigeria go enta street on Tuesday to protest ontop di detention of Zainab Habib Aliyu ontop accuse of drug trafficking for Saudi Arabia.
Zainab wey be student of Yusuf Maitama Sule University bin dey travel go for lesser Hajj, Umrah for December 2018 wen authorities for Saudi arrest am say she carry hard drug.
Tori be say dem plant di drug for her luggage and she bin no know until dem arrest her for Saudi Arabia.
Zainab don dey prison since dat time.
How di arrest happun
Zainab go Saudi for Umrah but she no fit do am because na di first day she land di kontri dem arrest am.
Dem arrest Zainab for di city of Madina for di presence of her mama and sister inside hotel wey dem bin lodge. Dem come dia room say dem see drugs inside bag wey match her passport so she get to follow dem.
Her sister Hajara Habib tell BBC Pidgin say dem dey tok to Zainab everyday, say she dey call wit di prison general phone.
"Sometimes she go dey off and you fit feel her sadness, loneliness and frustration.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Sometimes too she go dey lively especially wen we give her di update ontop her case.
Na so Hajara tok.

Wia dis foto come from, Hajara Habib
Who do Zainab dis bad tin?
Authorities for Nigeria don arrest seven pipo wey dem believe say put di drug for Zainab luggage.
Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) chook eye, come arrest seven staff of Aminu Kano Airport wen di tori reach dia ear.
Meanwhile goment too dey on di mata.
Senior Special Adviser to president Muhammadu Buhari ontop Foreign Relations and Diaspora say di president don order make di Attorney General of di kontri chook im eye for di mata.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Saudi Arabia no dey take ear hear mata wey relate to drug trafficking.
Most drug trafficking crime carry di capital punishment of death penalty.
Di students of di Yusuf Maitama Sule University dey protest on Tuesday so as to make goment go quick-quick settle di mata for Zainab to gain her freedom.













