Abike Dabiri-Erewa: Nigerians wey go rob for Dubai no be tribal mata

Wia dis foto come from, Gulf News
Federal goment of Nigeria say dem no carri bad for mind wen dem release di names of five of dia kontri pipo wey go rob for UAE.
Special Assistant to Presido Muhammadu Buhari on Diaspora mata, Abike Dabiri-Erewa na she tok dis one afta some Nigerians for social media begin drag her for her comments on di young men arrest for UAE wey go tiff for bureau de change.
"Dis no be about tribe or wia you come from. Wen you go out dia, you dey carri Nigerian passport," she tell BBC Pidgin.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Her tweet on di issue make some Nigerians accuse her say she dey target one ethnic group for di kontri.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4
"We suppose praise those wey go rob for Dubai?" Na wetin she ask our tori pesin wey ask her about di reactions of pipo for social media.
"If dem turn am to tribal thing for social media, na disgrace, no be something we suppose to encourage.
"Di names and pishures dey all over di place as di kontri (wia dem rob) officially release dem.

Wia dis foto come from, Abike Dabiri-Erewa
Madam dabiri-Erewa come add say di Nigerians go face di penalty of wetin dem do.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Dem comit crime and dat kontri get laws. You want make Nigeria go beg say some pipo rob...make dem go through fair trial.
"We no dey wash our hands from dem, but make dem get fair trial," she tok.
Tori be say di men go rob bureau de change for Sharjah, wey dey United Arab Emirates of about Dh2.3 million.

Wia dis foto come from, Gulf News
Camera catch dem as dem dey break enta di bureau de change and scata di glass before dem tiff and run.
Madam Dabiri-Erewa bin list dia names as Chimuanya Emmanuel Ozo, Benjamin Nwachukwu Ajah, Kingsley Ikenna Nwonka, Toochukwu Leonard Arise and Chile Micah Ndumodu.