Rivers State Govnorship Election 2019 Result: Nyesom Wike don win second term

Rivers State election: Nyesom Wike don win second term

Wia dis foto come from, Nyesom Wike

Read am in 2 mins

Rivers State Govnor Nyesom Wike don win re-election for second term.

Nigeria election office INEC declare Wike wey be PDP candidate re-elected on Wednesday evening wit 886,264 votes, according to Prof. Teddy Adias wey be di Returning Officer for di election.

Skip Facebook post, 1

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 1

AAC Biokpomabo Awara wit 173,859 votes carri second for di 9 March election.

Di result INEC declare na from 21 out of di 23 local goment aresa wey dey Rivers State.

Na Abua Odual and Gokana LGAs na im no get results from di govnorship election.

For Abua Odual, Dr Ferry Nwafor wey be Collation Officer say for security reasons, no election hold for dat local goment, sake of violence.

Di State Collation Officer Prof Teddy Adias say according to section 47 of INEC regulations and guidelines, dem go enta zero for di entire Abua Odual local goment.

Gbaranor Godwin Christian wey be di Collation officer for Gokana local goment say election hold but na wen dem wan do collation of results naim gbege start so Dem no fit do anything. Im say na for di DPO of Gokana office, im hand over evritin give di Electoral officer but im come add say dem no get any results sheet from di polling units so no results for Gokana local goment.

Di State Returning Officer Prof. Adias come take 30 minutes break afta which dem come back come declare Govnor Wike di winner.

Skip Facebook post, 2

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 2

Already PDP ogas don sama Congratulobia give Nyesom Wike as im win di election.

Atiku

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Saraki

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Govnor Okowa

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

Even Wike tweet say belle dey sweet am.

Skip X post, 4
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 4