Cameroon woman dem wit disability use fashion show preach gospel for access

About two million pipo di live wit disability for Cameroon according to World Health Organisation and most of dem no dey fit enta some buildings.

Disability show
Wetin we call dis foto, Vanessa Tontsa, mami pikin weh e dey for wheel chair send strong message for authorities for de first fashion show, ‘Access2019’ for woman dem wit disability for Cameroon.
Disability show
Wetin we call dis foto, Na 15 girl pikin and woman dem display dia beauty wit colourful dress for stage tori how deh no di lef anytin stop dem.
Disability show
Wetin we call dis foto, Vanessa e massa join e woman say even if e di hard some taim, disability no bi end of de world and notin di stop dem for anytin weh deh want.
Comfort Mussa
Wetin we call dis foto, Comfort Mussa weh na coordinator for SisterSpeak237 say de big palava for woman dem wit disability na say place laik bank, school, hospital, no get correct entrance as deh di only carri pipo wit disability inside.
Disability show
Wetin we call dis foto, About 2 million pipo di live wit disability for Cameroon as Marta Imamura sabi pesin for merecin weh e di shine eye for disability and rehabilitation for World Health Organisation bin tok.
Disability show
Wetin we call dis foto, Even pikin dem follow for di event.
Michele
Wetin we call dis foto, Michele na one of di participants.
Michele
Wetin we call dis foto, "Disable no means say all tin don finish, even wit disability woman fit born pikin."
Disability show
Wetin we call dis foto, Vanessa tell BBC News Pidgin how e meet e massa weh push e for runway.
Pikin dem
Wetin we call dis foto, Even pikin dem wit autism follow.
Disability show
Wetin we call dis foto, Say cheese.