Nigeria 2019 elections: Oversabi make some military men cause katakata for elections - Nigeria Defence HQ

Wia dis foto come from, Nigeria defence hq
Di Armed Forces of Nigeria and di Nigeria Police on Thursday blame some of di katakata wey happun during di 2019 elections on oversabi of some of dia men.
Inside statement wey di Armed Forces of Nigeria and di Nigeria Police release, di Defence headquarters tok say dem dey aware of all di complain from kontri pipo about how some security agents bin cause serious katakata for di election.
But di military say some of those security agents na political jaguda pipo wey dress like army and police to come cause kasala.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di military statement say e dey lawful according to section 217 of di 1999 constitution for army to join bodi wit police to provide security during election wen e dey necessary.
Police bin don alredi arrest 100 pipo wey dem suspect say be political jaguda pipo but army say dem still dey find more suspects.







