APC NWC suspension of Amosun, Okorocha no go stop dem to be Senators - INEC

Ibikunle Amosun and Rochas Okorocha

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ibikunle Amosun and Rochas Okorocha don give dia support to govnorship candidates from oda party wey no be APC

Nigeria election office INEC, say di suspension wey APC nack govnors Ibikunle Amosun and Rochas Okorocha no go stop dem from becoming senators for June because dem win dia elections on 23 February.

On Friday, 1 March, tori comot say di National working committee (NWC) of di All Progressives Congress (APC) suspend two of dia top-top members, although di confusion na whether dis one go put sand-sand for di garri of di two politicians career.

Amosun, wey be governor of Ogun State and Okorocha, di Imo State govnor chop di suspension on Friday afternoon for Abuja wia dia party claim say di two members involve for "anti-party activities".

Although di two politicians never react to di tori of dia suspension, INEC tell BBC say APC need to go settle dia internal mata but as for dem, di electoral joinbodi, di suspension no go block Amosun and Okorocha to become senators.

For di 23 February elections, Okorocha win Imo west senatorial seat and Amosun win for Ogun central, both of dem as members of APC.

Govnor Rochas Okorocha don reply Nigeria ruling APC National Working Committee wey suspend am on Friday sake of "anti-party activities"

Govnor Rochas Okorocha accuse di national chairman of di All Progressives Congress, Adams Oshiomhole of working hard to destroy di ruling party in inside South-East zone.

Okorocha say "Oshiomhole dey play di politics of 2023 inside 2019."

Di govnor wey tok say im his suspension from di ruling party no hold water also tok say di APC national chairman bin conduct "wuruwuru primaries inside di South-East."

Di govnor say e dey wrong for Oshiomhole wey dey lead di National Working Committee to treat am wit disgrace just two days afta im don work hard to ensure say president Muhammadu Buhari get re-election.

APC say dem don draw di attention of INEC national executive committee to let dem know say di two members no dey active again but INEC deny am.

Tok tok pesin for di election office, Rotimi Oyekanmi tell BBC say dem never receive any notice from di ruling party.