Election result update: "I humble say una find me worthy to kontinu"

Wia dis foto come from, @BashirAhmaad
Presido Muhammadu Buhari no waste time to tell Nigerians tank you, as dem vote am again to lead di kontri for second term.
For speech wey im make sharp sharp afta election bodi INEC declare am winner, presido Buhari say im dey "humble say pipo find am worthy to kontinu to serve."
Buhari say: "Although Saturday elections bin peaceful somehow, troublemakers for some states bin wan scata wetin dey go well. Security agencies go bring those wey dem arrest to face justice.
"I dey very sad say pipo die during di elections. Security agencies go step up to protect voters for di state elections wey dey come.
"I wan make special appeal to my supporters make dem no too make mouth or yeye di opposition. Our victory dey enough," im tok.
Im also add say im new goment go put more effort for security, restructuring di economy and to fight corruption.

Presido Buhari and im political party APC neva respond to di allegation wey di major opposition party don yan.
Di Chairman of INEC Professor Mahmood Yakubu na im bin lead di final collation process for Abuja.
End of Di one wey oda users dey read well well
Afta dem don count di vote finish for around 11.58pm on Tuesday, oga Yakubu say di commission go torchlight all di complains wey some party don make and dem go come back come finish di process.
Pipo for Nigeria bin go vote to choose di next President wey go run tins on February 23, 2019. Dis one na afta INEC first postpone di election based on logistics wahala.
For di result wey INEC don announce, President Buhari don score 15,191,847 votes while im closest opponent, Abubakar don score 11,262,978 votes. Omoyele Sowore wey bi di candidate of di Action Alliance Congress, AAC, na im come third with 33,953 votes.

Na 73 candidates dey find di Presido seat but di two main pipo be current President Muhammadu Buhari of APC and former Vice President Atiku Abubakar of di PDP.
Di announcement of di result drag sotay e take two days as di 36 states inside di kontri bin first collate dia results before dem present am for di Independent National Electoral Commission (INEC) collation center for Abuja.
As e be so, President Buhari bin clear most of di Northern states wella but di figures of pipo wey show up to vote na di lowest since Naija return to democracy for 1999.
Atiku neva tok, but im party PDP don open mouth
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Dem say make Nigerians reject di results from INEC until di Commission provide di data from di card reader accreditation at di polling units.
For social media, di hashtag #AtikuMakeThatCall dey trend, as pipo dey call on di PDP candidate to call Presido Buhari to accept say im lose di elections.
How di voting go

Wia dis foto come from, Getty Images
Atiku Abubakar no get luck at all for im polling station inside Yola, di capital of im state Adamawa, but im deliver di state wen e come to total number of votes wit 410,266 while Buhari get 378,078.
Di current President, Buhari dust Atiku for im own state Katsina wit 1,232,133 votes wey pass di 308,056 wey Atiku get.
Dem bin first arrange di election for February 16, but INEC delay am last minute, come change di date to February 23; dis one vex voters especially di pipo wey travel to vote.
Dis postponement even make di major political parties dey drag diasef say dem wan join bodi wit INEC to rig di election.
Some pipo dey tok say violence boku for inside di election.











