Karl Lagerfeld: Life & times of di ogbonge designer

Karl Lagerfeld

Wia dis foto come from, AFP/Getty

Read am in 3 mins

Superstar fashion designer Karl Lagerfeld die on Tuesday for di age of 85 years inside Paris afta one short sickness wey worry am.

Lagerfeld na one of di world most ogbonge designers for di heart of not one, not two, but three fashion houses wey include Chanel and Fendi.

Italian designer, Donatella Versace follow for many big-big pesin for di fashion industry wey pay last respect to late di designer.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Even America First Lady Melania Trump share foto for Twitter of one design wey Lagerfeld create for her first official White House appearance.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

wey be Lagerfeld own fashion brand CEO, described am as "creative genius".

Celebrities including Victoria Beckham, actress Diane Kruger and models Gigi and Bella Hadid don also pay dia tribute.

Na who be Karl Lagerfeld

Grey line wey dey
Paris. February 2008. Karl LAGERFELD dey greet di press afta one show.

Wia dis foto come from, Christopher Anderson/Magnum

Karl Lagerfeld for di creative top-top position for Chanel since 1983 and don dey design for Fendi since 1965. E also design collections for im own brand.

Dem born am as Karl Otto Lagerfeldt for pre-war Germany. E change im name because e believe say Lagerfeld sound like "commercial".

E come carry waka go Paris wen e be teenager, and come become di design assistant for Pierre Balmain.

Karl Lagerfeld on di phone

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Karl Lagerfeld for 1960, then im na di artistic director of di Jean Patou fashion brand
Presentational white space
Lagerfeld as im dey fit one of im designs on top model Ines de la Fressange for Chloe Paris studio.

Wia dis foto come from, Pierre Vauthey/Sygma/Getty Images

Wetin we call dis foto, Lagerfeld as im dey fit one of im designs on top model Ines de la Fressange for Chloe Paris studio.
Karl Lagerfeld, na artistic director of Chloé Paris, France.

Wia dis foto come from, Daniel SIMON/Gamma-Rapho/Getty Images

Wetin we call dis foto, Lagerfeld as im dey work on design sketches for Chloe Paris studio.
Presentational white space

E begin im career wit Chanel for 1983, 10 years afta Coco Chanel die. For 1984 e launch im own name label.

E also don collaborate wit high street brand H&M - before high-end collaboration come dey very common.

Lagerfeld looks come dey very popular for im later years - e go wear dark suits and leather gloves wit im signature white pony-tail, black boots and tinted sunglasses.

Lagerfeld also bring change to di catwalk. For di Chanel AW14 show inside Paris e become high-end supermarket.

Dem also know as pesin wey encourage new designers, like Victoria Beckham - who don praise am for im kindness.

Fashion Designer Karl Lagerfeld and model Cara Delevingne appear for di end of di runway during di Chanel show as part of di Paris Fashion Week Womenswear Fall/Winter 2014-2015 on March 4, 2014 inside Paris, France.

Wia dis foto come from, Francois Durand/Getty Images

For 2016 Chanel stage one dia show for di Cuban capital Havana - di first international fashion show since 1959 communist revolution, for di two foto below.

World celebrities gada for di event even though dem no dey sell Chanel goods for Cuba.

Karl Lagerfeld wey be head designer and creative director of fashion house Chanel, waka wit one model afta one fashion show of im latest inter-seasonal Cruise collection, for di Paseo del Prado street inside Havana, Cuba.

Wia dis foto come from, Reuters

Models present creations by German designer Karl Lagerfeld as part of im latest inter-seasonal Cruise collection for fashion house Chanel for di Paseo del Prado street inside Havana, Cuba, May 3, 2016.

Wia dis foto come from, Reuters

Celebrities - including actor Vin Diesel and supermodel Gisele Bundchen - attended the show at Havana's Prado promenade to see Lagerfeld displaying the new collection. Lagerfeld said the line was inspired by Cuba's "cultural richness".

Katy Perry, Karl Lagerfeld, Cara Delevingne and Claudia Schiffer

Wia dis foto come from, Shutterstock

Wetin we call dis foto, Katy Perry, Karl Lagerfeld, Cara Delevingne and Claudia Schiffer for di Chanel show, Fall Winter 2017, Haute Couture Fashion Week, inside Paris
Lady Gaga and Karl Lagerfeld

Wia dis foto come from, Shutterstock

Wetin we call dis foto, Lady Gaga and Karl Lagerfeld for di Celine show, Spring Summer 2019, Paris Fashion Week

Di designer bin no dey well for plenti weeks, and don mis plenti number of fashion shows.

German fashion designer Karl Lagerfeld for Chanel dey greet di public for di end of im 2014 Spring/Summer ready-to-wear collection fashion show for di Grand Palais inside Paris.

Wia dis foto come from, AFP

Presentational white space