Walter Onnoghen finally appear for Code of Conduct Tribunal, plead not guilty

Justice Walter Onnoghen

Wia dis foto come from, NIGERIA BAR ASSOCIATION

Wetin we call dis foto, Onnoghen dey face false declaration of assets accuse for di CCT

One powerful Nigerian judge wey President Muhammadu Buhari bin suspend for January finally appear for court to face trial on Friday

Justice Walter Onnoghen wey chop suspension as Chief Justice of Nigeria, show face for Code of Conduct Tribunal to ansa charge say im no declare all im property im get before e start work for 2017.

Justice Onnoghen plead not guilty to 6-count charge against him, den Code of Conduct Tribunal don remove di arrest warrant dem bin sama for im head.