Anglophone Crisis: Some pipo hear gun music, odas celebrate National Youth Day wit patriotic songs

President Paul Biya

Wia dis foto come from, President Paul BIYA/Twitter

Wetin we call dis foto, Cameroon President Paul Biya
Read am in 1 mins

Some young pipo for Anglophone regions hear na gun music on Monday as dia kombi dem for oda parts di march wit patriotic songs for celebrate number 53 national youth day.

Separatists dem force pipo for remain inside house for ten days, 'lockdown' for spoil de youth day but even wit gunshots some young pipo march for de two regions.

Gun music 'Youth Day' for Anglophone region

On Monday morning Bamenda resident tell BBC News pidgin say gun di fire for different areas.

Only one secondary school wit five pikin dem and na University of Bamenda plenti for de march for Commercial Avenue, Bamenda wit plenty security around.

Den for Buea, sound for gun force some youths dem for remain for house, anode resident tok.

Separatists force 'lockdown' for Northwest and Southwest pipo for spoil celebration for Youth Day on Monday.

President Biya message

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

For yi message for youths President Biya no even tok about youths dem for de two regions some weh deh no di go school for more dan two years.

President Biya say e don create 500,000 jobs dem last year and dis year e go create cover 500,000 jobs and training centre for train trainers for Yaounde.

E say goment go fight den bad tins dem weh deh di destroy youths dem laik alcohol and drug abuse.

President Biya say make youths no lose hope say na dem go build Cameroon for tomorrow.