ASUU strike: Lecturers say N16.8bn to settle dia salary igbese no dey enof to end strike

Wia dis foto come from, Getty Images
Professor Biodun Ogunyemi wey be Presido of Academic Staff Union of Universities (ASUU) say moni wey goment release moni to pay dia salary igbese, no dey enof to end dia strike.
Nigeria Federal Goment bin release N16.8 billion for schools to use settle salary igbese of lecturers for di kontri higher institutions.
But Prof Biodun Ogunyemi wey im union don dey strike since Novermber 2018, say as e get oda tins wey dem still dey fight for from goment, before dem call di strike off.
Prof. Ogunyemi say di agreement wey goment dey claim say dem reach wit dia union na just proposal and ASUU neva sign anytin wit dem.
Minister of Education, Malam Adamu Adamu bin announce di payment of N16.8bn to tori pipo for Abuja. Oga Malam Adamu tok say as goment don settle all di complain wey di Academic Staff Union of Universities and di Academic Staff Union of Polytechnics bring come, dem dey wait for di unions to end dia strike.
ASUU don dey strike since 4 November 2018 while ASUP start dia own strike since December 12.
Malam Adamu still add say some of di areas wey goment reach agreement wit di unions na review of Polytechnic Act, renegotiation of di 2010 agreements wey go upgrade facilities for public higher institutions.
ASUU say dem go meet again wit goment on Thursday, 7 February 2019.
End of Di one wey oda users dey read well well












