Super blood wolf moon as e happun inside foto

Wia dis foto come from, SPL

Pipo wey dey look stars don dey check di sky for highly unusual lunar eclipse wey start for Sunday night.
Di thing we dem dey call "super blood wolf moon", go show di moon change colour to red and e go shine brighter and go look like say e dey closer to earth dan normal.
Di event wey first dey visible from North and South America, as well as parts of Western Europe. For UK, some clouds block di view.
Di next total lunar eclipse go happen in two years, on 26 May 2021.

Wia dis foto come from, Reuters
"A little bit of sunlight change direction because of earth's atmosphere and reach di moon and go bend around di edge of di earth" na wetin Walter Freeman, assistant teaching professor for Syracuse University for New York State.
"Dis small amount of red light dey shine light for di moon so we fit see."

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Reuters

Dis kind eclipse dey happen when di earth pass between di Sun and di Moon.
For dis situation, di Sun dey behind di Earth, and di Moon enter inside Earth shadow.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di eclipse start for 02:35 GMT for Monday and e end for 07:49 GMT, but di point wen di greatest eclipse happen na for 05:12 GMT.


Wia dis foto come from, AFP/Getty

Dem dey call am "super" because di moon go dey near di earth - and e go be bigger for di sky.
Di "wolf" part come from di name wey dem dey give full moons for January - "wolf moons"


Wia dis foto come from, PA

Wia dis foto come from, EPA
All pictures get copyright











