Boo di Pomeranian dog don die 'from heartbreak'

Boo di Pomeranian dog

Wia dis foto come from, Boo/Facebook

Read am in 1 mins

Social media star Boo di Pomeranian dog don die for di age of 12.

Im owners say im show sign of heart problems eva since im "best friend" - anoda dog wey im name na Buddy die for 2017.

"We believe say im heart break since Buddy leave us," na so dem write for im official Facebook page.

Boo get 16 million follower for Facebook, make TV appearance, and even release bok wey di name na Boo - di life of di world's cutest dog.

Boo and im friend Buddy don live togeda for 11 years before Buddy die for September 2017 for di age of 14.

Im owners wey come from di US, say Boo die for im sleep early Saturday morning and dem dey "heartbroken".

Dem add say "Boo, we love you wit all our heart and we go miss you until di day we meet again."

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post