BBC Akwa Ibom debate: Wetin we wan see on dat day - Residents
Na one day to di BBC Pidgin Govnorship debate for Uyo, Akwa Ibom state, South South Nigeria.
As preparations dey go on, pipo wey dey live for di state don open up yan about wetin dem wan see for di debate.
From education to youth unemployment, di pipo share with BBC Pidgin dia expectations for di Thursday debate.

