Who be Cameroon new Prime minister, Dion Ngouté Joseph

Paul Biya

Wia dis foto come from, BERTRAND GUAY

President Paul Biya of Cameroon don name new prime minister.

De new prime minister na Joseph Dion Ngute weh e di replace Philemon Yang.

Pipo bin di wait new goment afta Biya win October 7 election for rule for anoda seven years afta e don make 36 for pawa.

Who bi new Cameroon PM?

Dion Ngouté Joseph

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dion Ngouté Joseph

Deh born new Prime Minister Joseph dion Ngute for number 12 day for March 1954, for Bongongo Barombi for ekondo Titi sub-division for Ndian division, Southwest region.

Dion Ngute na chief for Bongongo village and e go school for Bilingual grammar school for Molyko for 1971.

E get degree for law from University of Yaounde 1 for 1977 and maters from University of London and PHD from Valvivk University for America.

Dion Ngute bin bi director for Advanced School of Administration and Magistracy, ENAM for ten years.

De ruling party CPDM central committee mimba bin bi minister delegate for minister of external relations in-charge of Commonwealth till March 2018. Afta deh appoint e minister for special duties for presidency.

Chief Dion Ngute di represent Cameroon for United Nations Commission for Refugees for Geneva and African Commission for Peoples Rights for Banjoul.

No bi new man for goment as e don bi 22 years for goment.