Nigeria Police don arrest Senator Dino Melaye

Senator Dino Melaye

Wia dis foto come from, @DINOMELAYE (INSTAGRAM)

Tori as e dey hot be say Nigerian senator Dino Melaye don surrender to police.

As di mata be so, Melaye hand over imsef to di police afta one week wey dem tanda for im domot.

Di accuse on top im head be say im boys shoot one policeman, but di senator deny di allegation.

BBC tori pesin wey follow see as officers arrest Melaye tok say dem dey carry am go SARS headquarters for Abuja, Nigeria capital.

Before now di senator bin say di reason why e no go surrender himself to police be say dem go give am injection wey go kill am.

On Wednesday, January 2, di Senator enta Twitter tok say Police don bring different equipment wey dem go use break into im house.