U.S Embassy for Nigeria don re-open shop afta dem close till further notice

Wia dis foto come from, Twitter/@USEmbassyAbuja
America Embassy for Nigeria don reopen afta dem close down dia centres for Abuja and Lagos on New Year's Eve till further notice.
Di embassy late Tuesday clarify dia first announcement dem bin give. Now dem say di Embassy for Abuja and Consulate General for Lagos go dey open for consular business, including visa interviews.
Dem share di message for night on January 1 top social media.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
According to di informate dem put on Monday December 31, 2018ontop dia Facebook page, di shut down na as a result of wetin dey happun for U.S.
Since December 22, 2018 na im America goment shut down because dem never agree for di moni wey President Donald Trump want to fund di wall e wan build for Mexico wey fit cost billions of dollars.
Nigeria embassy say dem go open again once di goment shutdown for America don end too.
Although di embassy no tok go dia, wetin di shut down mean for pipo wey get one visa appointment or di oda na say dem go get to exercise patience till dem open again
Di shutdown don already affect tins for America as contracts dey on hold for many federal office for U.S, travel plans cancel and many pipo never collect salary.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na like 420,000 pipo dey work on New Year eve without pay.














