Shehu Shagari, former Nigeria presido don die

Shagari bin be Nigeria presido from1979 to 1983 afta e collect power from General Olusegun Obasanjo wey be di military Head of State den.
Read am in 1 mins

Nigeria former presido Alhaji Shehu Shagari die on Friday.

93 year old Shagari die afta e sick small for National hospital, Abuja, according to im family member.

Shagari bin be Nigeria presido from 1979 to 1983 afta e collect power from General Olusegun Obasanjo wey be di military Head of State den.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Na Saturday afternoon, dem go burial di former presido for Shagari village for Sokoto state, northwest Nigeria by 2pm according to Muslim rites.

Dem born di former presido wey full name na Shehu Usman Aliyu Shagari for di northern Shagari village on February 25, 1925.

Im bin marry three wives; Amina, Aishatu, Hadiza Shagari and get many pikins.

Shehu Shagari great-grandfather, Ahmadu Rufa'i, na di founder of di village and di village head.