Ekene Ngige: 'Di artist wey dey use coffee dey draw'

Coffee na wetin pesin dey drink to take ginger bodi but dis artiste no tink say e end dia.

Ekene Ngige dey use coffee take tell tori about life for Nigeria.

Once im don put brush inside di coffee, e dey paint tins wey dey surprise pipo.

Di tins wey Ekene dey shine light ontop wit im paint na tins wey dey give pipo hope.

Ekene Ngige begin tell story with coffee for 2015.

Video: Dan Ikpoyi