Nigeria secret service don arrest 'fake first lady'

Amina Mohammed

Wia dis foto come from, Punch

Wetin we call dis foto, Investigators say Amina Mohammed use mago mago collect $414,000 from one businessman

Authorities don arrest one woman wey dem claim say use fake identities to enta di presidential villa compound in oda to dey do business magomago.

Di secret service say Amina Mohammed first do like say im be Kogi state first lady to gain entry inside di presidential villa for di capital, Abuja.

Dem claim say she come invite more pipo to di villa to make dem believe say na di president wife dey give dem appointment.

For meeting wit tori pipo about di arrest, madam Mohammed shout: "Na lie."

Peter Afunanya, tok-tok pesin for Department of State Security (DSS), tell tori pipo say di gbege bin first happun wen First Lady Aisha Buhari din dey outside di kontri for November 2017.

Rich businessman Alexander Chika Okafor, wey madam Mohammed invite come presidential villa, dey accuse her say she kolobi from am N150m ($414,000, £323,000) ontop one property for Lagos, di secret service tok.

"Investigation don show say di first lady no sabi anything about dis unholy enterprise," Oga Afunanya tok.

Madam Mohammed "use advantage sake of say pipo like first ladies, ministers and oda type of officials no dey go through serious protocols and security checks for di villa entrance", im tok join.

Aisha Buhari and Preseident Muhammadu Buhari for im inauguration

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Di main koko of Buhari campaign na against corruption

Ishaq Khalid of di BBC wey dey Abuja say di security breach dey shocking as di presidential complex, wey dem also dey call Aso Rock, get serious protection from DSS and police officers.

All staff wey dey work dia need to have something like ID card wey get biometric information on top, and all visitors need to sign to enta, Khalid tok.

For September, di DSS arrest one of di first lady aides for allegedly im go raise money wey dem no oda am to do. Di man deny all di allegations.

President Muhammadu Buhari, wey dey contest re-election for February, enta office onto promise say im goment tackle di plenti corruption wey dey Nigeria.