Port Harcourt: Pesin don cut corner somewia wey make building collapse - Tonye Cole

- Author, Karina Igonikon
- Role, BBC News Pidgin, Port Harcourt
Tonye Cole wey be di candidate of di All Progressives Congress (APC) for di govnorship election for Rivers State, say goment need to find out who dey responsible for building wey collapse.
Five pipo na im dem don confam say die so far and many odas get wound afta seven story building collapse on Friday for Port Harcourt, di Rivers State capital.
Di building wey still dey under construction collapse for di Woji GRA part of di Rivers State capital.
Cole wey be architect, say "sometin bin dey wrong wit di building code or building ethics."
"Sometin happun, one structural defect go don dey, so sombodi go don cut corner somwia.
"As human being life dey involved, e dey critical to identify which pesin get di fault," im tok.
Di state Commissioner of Special Duties John Bazia bin confam di five pipo wey die and say dem don rescue 28 pipo so far.
Rescuers still dey search for more pipo wey dey trap under.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Rivers State Govt House
Even as volunteers dey ground and rescue efforts still dey go on, many family members of pipo wey still trap inside don dey lose hope say dia pesin go survive since Friday wey dem trap inside.
"My broda Ekene still dey inside." Na so Chikodi tell BBC Pidgin. "Di man wey get di building call am make im come collect money for tins im go supply on Monday na im make im come, come enter dis tin. Im get shop for Mile 3 market and since yesterday we dey call im line di number no dey go." Na so she tok.

Wia dis foto come from, Sele Aso/Facebook
According to tori, many of di victims be construction workers and pipo wey dey sell market dia.
Meanwhile Rivers State Goment say dem go chook eye to find out wetin make di building wey dey under construction to collapse.
Chief of Staff Goment House Emeka Woke say any pesin wey get fault for wetin happun go face di law.














