2019 Election: How much politicians dey pay for vote buying?
Former President Goodluck Jonathan wen e launch im book 'My Transition Hours' tok say vote buying na di main rigging formula wey don replace oda types of election wuruwuru for Nigeria.
So BBC News Pidgin enta street to find out wetin dey make pipo sell dia vote and how much pesin go pay to buy your vote for Nigeria.