How MTN Payment Service Bank go work for Nigeria

MTN, na Africa biggest telephone company

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, MTN, na Africa biggest telephone company

Rob Shuter, wey be oga patapata of telephone company MTN Group, say im company wan get banking licence for Nigeria by 2019.

Shuter tok dis one for one telecoms conference for Cape Town, South Africa, wia m say dem go send dia application for December and lunch di bank for second quarter for 2019.

"We go apply for payment service banking licence for Nigeria by next month," na wetin im tok.

Di banking license na for Payment Service Bank (PSB), wey be initiative of Central Bank of Nigeria to make everybodi get bank account for di kontri.

For October, CBN release guidelines for payment service banks, wey include N2m non-refundable licence fee and N5bn capital base.

CBN guideline na for telephone company dem, mobile money operators, banking agents, and NCC.

MTN

Wia dis foto come from, MTN

How Payment Service Banks go work for Nigeria

  • Dem go operate for villages. For di villages wia dem go operate, half of dia agent go dey work for di area.
  • ATM dem go dey for some of di areas dem
  • Dem go use electronic platform to reach customers. Dis one mean say dem go use (email, text message and mobile app)
  • Dem go get consumer help desk for dia head office and coordinating centres wey go dey handle issues wey customer get
  • Di kain technology wey dem go use go match di best wey dem dey use for data storage; security and integrity.