Lai Mohammed: N3.5m tok na fat lie! 'El-Zakzaky dey buy food im dey chop since goment arrest am' - Lawyer to Shia leader

Lai Mohammed

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI

Wetin we call dis foto, Lai Mohammed say El Zakzaky dey safe
Read am in 2 mins

Ibrahim El-Zakzaky laywer tell BBC News Pidgin on Thursday say 'Alhaji Lai Mohammed dey lie, na El-Zakzaky dey buy di food im dey chop, and electricity card wey im dey use get light since goment arrest am'.

Haruna Magashi wey El-Zakzaky lawyer tok dis one as im dey react to Nigeria goment claim say dem dey spend N3.5 million evri month to feed di Shia leader.

"Dis na wetin I don take my eye see and wetin El-Zakzaky don tell me, since im detention, na im don dey take care of imsef, na im dey buy im own food"

'Goment suppose shame say man of dat kain status go dey tok lie lie anyhow'

Tori be say Alhaji Lai Mohammed, Nigeria Minister of Information, say di federal goment dey spend N3.5m everi month take feed Ibrahim El-Zakzaky, di leader of Nigeria Islamic Movement wey dey dia hand.

Tori pipo Oaks TV na dem release video of press conference wit tori pipo wia oga Mohammed tok dis wan on Wednesday afta Federal Executive Council meeting.

Skip YouTube post
Allow Google YouTube content?

Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of YouTube post

Even card unit for light and fuel for generator, na from El-Zakzaky pocket, tok di lawyer wey say im see im client last for court on 7 November, 2018, Magashi tok.

Lai Mohammed

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Lai Mohammed say na na N3.5 million dem tell am when e ask how much dem use feed El-Zakzaky

'Na lie oga Lai Mohammed dey lie, in fact na pipo from Islamic Movement of Nigeria joinbodi dey even arrange tins go carri go give El-Zakzaky', Muhammad Ibrahim Gamawa wey be one oga for di Muslim group dey tell BBC News Pidgin

"Dis no be di first time im don tell Nigerians bull****"

Gamawa wey be Resource officer for IMN say im no understand wetin or who di goment dey spend N3.5 million ontop, but no be Ibrahim El-Zakzaky.

"Even di generator for di Abuja place wia dem keep am put, na we (IMN) buy am," tok Gamawa.

El-Zakzaky banner

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, El-Zakzaky don dey hand of Nigeria security agency DSS since 2015 without bail or release

IMN accuse goment say dem no dey treat dia leader well, say even El-Zakzaky high blood pressure melecine, goment neva give am for di past four months.

"Who ask dem to dey waste tax payers money? wen court order don sake make dem release El-Zakzaky... [Lai Mohammed] dey for Abuja dey jolly with im family inside air conditioner, no bullet dey inside im bodi," Gawama para give BBC News Pidgin.

IMN confam say Department of State Security (DSS) don move El-Zakzaky from di kontri capital Abuja, go Kaduna State but dem never grant di Shiite leader bail or release am.