Prince Charles don collect Kumasi accolade

Prince Charles visits Africa

APrince Charles of Wales wey be Queen Elizabeth first son collect Kumasi accolade on Sunday wit durbar.

Asantehene Otumfuo Osei Tutu II hold durbar take honour Prince of Wales, Prince Charles den en wife Camilla, di Duchess of Cornwall for Manyhia Palace as dem waka for Ghana since Thursday November 1.

Dis waka for Ghana for follow join di Prince Africa visit to west Africa wey start on Wednesday October 31.

Check how Asanteman dey display dema colourful tradition give dema Royal visitors.

Asanteman dey display dema colourful tradition
Wetin we call dis foto, Asanteman dey display dema colourful tradition
Asanteman dey display dema colourful tradition
Wetin we call dis foto, Pipo for ashanti or Asante as dem dey call am for Ghana dey speak Asante dialect of Twi
Gold full for Asante region
Wetin we call dis foto, Gold full for Asante region and dis Gold na one of Ghana main natural resources wey demma export