Asamoah Gyan file for divorce, he wan DNA test to prove say en kids be en own true-true

Asamoah Gyan

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 1 mins

Ghanaian footballer den Black Stars captain Asamoah Gyan file for divorce from en wife for High Court in Accra.

Also Asamoah Gyan according to reports dey demand for DNA test to prove say di three children be en own or not.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

According to Ghanaweb.com, di Black Stars captain file for divorce around August this year after dem start dey get issues.

Meanwhile, he start dey make plans to marry some business woman for Accra after di court end he den en current wife dema marriage.

Asamoah Gyan den en wife Gifty dey inside relationship since 2003 wey dem marry 2013 after dema second child.