Plenti pipo don wound afta Shiites and Nigerian soldiers jam for Abuja

Tori be say plenti Shiites members wound for di kwanta, according to pipo wey dey live for Nyanya axis but we no fit confam di tori now.

Wia dis foto come from, Ibrahim Musa

Read am in 2 mins

Tori wey just land be say Shiites and soldiers dey fight around Nyanya area for Abuja, Nigeria.

Pipo wey take eye see how e hapun tell BBC News Pidgin say di Shiite members dem bin dey procession while odas dey car, wen dem reach Military checkpoint dem ask dem to turn back but dem no gree.

Skip Facebook post, 1

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 1

BBC tori pesin wey dey di area dey hear gunshot anyhow and goment don block di Kubwa express road sake of di kwanta.

Di soldiers come start to dey shoot for air to try shake dem but instead make dem clear, dem start to dey stone di soldier dem, na wetin eyewitness tell BBC News Pidgin.

Wetin we call dis Video, Shiites: Fear-fear for Abuja as El-Zakzaky supporters wan do anoda march

Na dis one vex di soldiers wey come face dem.

Tori be say plenti Shiites members wound for di kwanta, according to pipo wey dey live for Nyanya axis but we no fit confam di tori now.

Kasala burst on Monday for protest wey Islamic Movement (Nigeria) dey do for di area.

Shiites and soldiers dey fight around Nyanya area for Abuja

Wia dis foto come from, Facebook/Shaheed Asperger

Maxwell Kyon, di lawyer of di Shiite leader Ibrahim El-Zakzaky say around dis period every year dem dey do one march wey dey compulsory for dia religion.

E say during di march, dem dey tok and sing about dia leader wey dey prison, e say evritime dem come out to do am army dey always attack dem instead of dem to protect dem.

Nigerians don enta social media about di fight.

Skip Facebook post, 2

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 2

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Dis one na as army confam on Sunday say three members of Shiite Muslim group die and two of dem soldiers wound for one fight for Zuba area on Saturday.

Security bin don dey ground for some strategic pace for Abuja and Nyanya-Nasarawa axis.