I dey come revenge for IPOB members and my dog wey die - Nnamdi Kanu

Wia dis foto come from, Elliot Ugochukwu-Ukoh
Nnamdi Kanu, leader of di Indigenous Peoples of Biafra, IPOB, wey don run comot from Nigeria since September 2017, don tok say im dey come back to revenge.
Kanu wey tok dis one on Sunday, October 21 on top radio Biafra, come boast say "no human being fit kill me, I go return to Biafra land."
Di IPOB leader say im dey speak from Israel. Im tok say na 28 IPOB members die for im papa compound di day wey im run comot from Nigeria after some pipo wey im claim say na Nigerian soldiers, try kill am.
Kanu come promise say IPOB go revenge di death of di 28 members plus im cousin and dog.
Meanwhile, Nigeria goment never chook mouth on top wetin Kanu tok.
Lai Mohammed wey be Minister of Information for Nigeria, tell BBC Pidgin say goment don see di video wey show say Kanu dey for Israel and dem go soon tok dia mind about am.
"We don see di video, make una wait small, we go release statement about am," im tok.
Kanu 'miss' since 14 September 2017, afta Nigeria military launch Operation Python Dance II to stop di protests wey some pipo dey do to demand for Republic of Biafra from Nigeria.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis protests dem bin dey happun for some areas for south east Nigeria wia IPOB get strong leg.
Di Nigerian court bin declare 'IPOB as terrorist group' - Nigeria High Court wey come make goment ban all activities by di group for 2017.
Lai Mohammed no gree ansa weda goment go ask Israel to arrest Kanu, send am back to Nigeria.











