Ganduje Video: Jafaar Jafaar don ready to help Kano lawmakers

Wetin we call dis Video, Jafaar Jafaar say lawyers dey look di invitation wey Kano lawmakers send dem

Jaafar Jaafar, editor of tori pipo Daily Nigerian, wey break tori say Kano State govnor Umar Ganduje dey 'collect' don say im dey ready to honour Kano State House of Assembly invitation to help dia investigation.

Kano State House of Assembly investigative panel bin invite Jaafar to come show face for di assembly for inside letter on Thursday.

Jaafar say im lawyers dey "currently study di invitation letter wey dem give dem and dem go soon reply dem wit certain conditions wey concern im safety."

Di invitation by di Kano State House of Assembly na for di oga of di tori company to come tell di committee wey dey investigate Ganduje allegations wetin dem see and wetin dem really know.

Abdullahi Ganduje

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kano State govnor Abdullahi Ganduje wan sue tori pipo Daily Nigerian newspaper say dem dey spoil e name.

"All di hearing go dey public... you go get chance to tok as you see di mata, show evidence and ask questions," na so di letter tok.

House majority leader, Bappa Dan Agundi bin tok on Monday say dem fit impeach dia govnor if di investigation prove say true true Ganduje way no dey pure.

Letter to Daily Nigerian

Wia dis foto come from, Kano State House of Assembly

Wetin we call dis foto, Di meeting date na Friday, 26 October and di editor fit cari im lawyer come, if e want

We neva see di video

On Monday, when BBC News Pidgin tori pesin Mansur Abubakar follow EFCC spokespesin Wilson Uwujaren tok, e say di agency no dey aware of di video.

"I no dey aware of any video, I neva see am." Na wetin Uwujaren tell BBC Pidgin for telephone.

Na EFCC dey in charge of a investigating anything wey resemble corruption for Nigeria and many pipo dey expect say since di video don dey public domain, dem go start dia work.

Under Nigeria law, govnors follow for those wey dey enjoy immunity, so notin fit happun to govnor Ganduje wen im still dey office.