Hauwa Liman: Na heartbreak say dem kill Hauwa Liman - ICRC

Wetin we call dis Video, Hauwa Liman: Pipo dey cry dey mourn

Many pipo still shock on top di tori of how Islamic militants kill Hauwa Liman, di health worker wey dem kidnap for northern Nigeria.

Di International Committee of di Red Cross, ICRC, say di tori na 'heartbreak' and e still dey shock dem why dem go kill two female health workers back-to-back just like dat.

Bring Back Our Girls Group do protest on Tuesday 16 October for di capital Abuja to ginger goment about di aid worker.

Nigeria goment say di killing dey 'inhuman and ungodly'.

Na militant group, Islamic State West Africa Province (Iswap), kidnap Ms Liman, plus anoda midwife, Saifura Ahmed Khorsa for Rann, Borno state.

Di two bin dey work for IDP camp to help pipo wey escape militant attack for di region.

Last month, dem kill Ms Khorsa.

Nigeria presidential candidate Oby Ezekwesili wey be member of di group, dey wit oda members and she begin cry as she no fit control wetin dey pain her for belle.

Many pipo wey come out for di waka, cari long face as di girl wey di group kill still dey pain everibodi for bodi.

Nigeria police
Wetin we call dis foto, Police officers stand for road wia Bring Back our Girls Group dey do peaceful protest
BBOG
Wetin we call dis foto, Na from as early as 8am pipo begin come out
BBOG
Wetin we call dis foto, Di militants group still hold Leah Sharibu wey be di only Chibok school girl wey remain for dia hand, and Alice Loksha wey dem bin catch for Rann
BBOG
Wetin we call dis foto, Nigeria goment bin say dem try do evritin dem fit, to rescue Hauwa wey di group kill