Obasanjo don change mouth about Atiku two months afta im swear wit God name not to support am

Atiku Abubakar

Wia dis foto come from, Twitter/@atiku

Wetin we call dis foto, Alhaji Atiku bin dey di house of di former Nigerian president for Abeokuta, Ogun State south west of di kontri on Thursday 12 October
Read am in 2 mins

Presido Muhammadu Buhari office last night tok say dem no surprise say former presido Olusegun Obasanjo make U-turn to anoint Atiku Abubakar for 2019 election.

Garba Shehu, di tok tok pesin to Presido Buhari say wetin happun for Abeokuta on Thursday afternoon na well-rehearsed drama.

"Dem go lose togeda. As I listen to di prepared statement of di former President after di meeting e show di usual ego trip and "Sabi-sabi" character of Chief Obasanjo", Shehu tok.

Alhaji Atiku Abubakar wey be di presidential candidate of People's Democratic Party, PDP, don receive di blessing of former President Olusegun Obasanjo to be Nigeria next presido.

Obasanjo bin don tok before say im no go ever support im former deputy to be president and for August dis year for interview wit tori pipo Premium Times, even use God name swear.

Atiku, go Obasanjo house wit pipo wey include PDP National Chairman, Uche Secondus, and di Director General of di Atiku Campaign Organisation, Gbenga Daniel and Senator Ben Murray-Bruce.

Atiku and Obasanjo

Wia dis foto come from, Ben Muray-Bruce

Wetin we call dis foto, Obasanjo bin don swear say im no go ever support Atiku to be president of Nigeria

Atiku na second in command to Obasanjo for Nigeria between 1999 and 2007. But two of dem begin kwanta wey make baba Obasanjo swear say im no go ever support Atiku to be president of Nigeria.

Di two men enta inside house, close door begin do dia meeting wen Atiku reach di house on Thursday.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Obasanjo no dey PDP again, and afta im burn im card for public, e no dey clear which kain support im fit give Atiku.

Di former president get mouth wella for im kontri, and bin don advise President Muhammadu Buhari say make im pack im load go wen im tenure expire next year.

Atiku and Obasanjo

Wia dis foto come from, Ben Murray-Bruce

Wetin we call dis foto, Pipo dey say na Atiku go challenge Buhari for Nigeria presido seat next year