Elections Cameroon say e no stop voter for use phone for polling station

Cameroon election

Wia dis foto come from, ISSOUF SANOGO

Wetin we call dis foto, Cameroon go vote for president on October 7
Read am in 1 mins

Elections Cameroon - ELECAM de organ weh e di manage elections don deny de kongasa say voters no go use dia phone for polling station.

ELECAM Director, Erik Essousse don say election law no di stop voters for use dia phone for polling stations.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

ELECAM reaction komot afta weh some foto with telephone weh deh mark x ontop di circulate for ELECAM regional centre e Facebook account.

Den wen newspapers and pipo damn de message, e vanish from ELECAM regional centre e page.

Before ELECAM say na lie say make voter no use telephone for polling station, one presidential candidate for PURS party, Serge Espoire Matomba bin don komot release condemn de decision.

Informate

Wia dis foto come from, Other

Even main opposition, Social Democratic Party, SDF, member for parliament bin don Jean Michel Nintcheu bin announce say e go organise protest for condemn de decision.

Hon. Nintcheu bin don tok say na way for tief results for election.

Cameroon di elect president for number 7 day for October and na around 6.7 million kontri pipo register for vote out of about 22 million population.