Nigeria Elections 2019: British goment say dem go help Nigeria achieve free and fair elections

Deputy British High Commissioner to Nigeria, Laure Beaufils and Rivers state govnor Nyesom Wike
Wetin we call dis foto, Deputy British High Commissioner to Nigeria, Laure Beaufils and Rivers state govnor Nyesom Wike

Di Deputy British High Commissioner to Nigeria, Laure Beaufils don tok say UK goment go work wit pipo wey e concern to make sure di 2019 elections for Nigeria go dey peaceful, free and fair.

She tok dis one afta she get close door meeting with Govnor Nyesom Wike for govment house for Port Harcourt, Rivers State, south south Nigeria.

Beaufils come advise Nigeria election bodi, di Independent National Electoral Commission (INEC) to improve di technical levels wey dem achieve inside last weekend Osun State elections against next year elections.

Beaufils tok say, "we don see plenti technical progress for di Osun State election. Dis na good progress wey we hope say go happun all over di kontri for 2019''.

She still tok say, ''dis na somtin we dey chook eye inside and we dey work with INEC for more progress''.

Govnor Wike come say Rivers state dey ready gidigba for peaceful, free and fair elections but say make international tori pipo, INEC and security agencies for di kontri to comot dia hand for voting and allow pipo choose who dem want.