South Africa don legit marijuana for private use

Wia dis foto come from, The Times
South Africa highest court don legalise igbo for di kontri as far as na adults dey take am for private place.
Na all di judges for di Constitutional Court vote to make di natural drug legal for di kontri.
South Africa goment bin don try to dey ban di drug wey dem say no dey good for pipo health but dem neva tok about dis new judgement.
Na three igbo users wey get charges on top dem head cari case go di highest court say di ban against di drug no get good reason.
But even as e don dey legal to take am for private, e still no dey legit to take am or sell for public place.
South Africa go be di first African kontri wey go legalise igbo or marijuana as dem be di third kontri for world.
Di oda two na Uruguay wey legalize am for 2013 and Canada become di second to legalize am for June dis year.







