Rat wey die inside soup don land Chinese restaurant $190m loss

Hotpot restaurant Xiabu Xiabu

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di dead rat been dey inside di boiling pot

One big Chinese restaurant don chop $190m fine afta pregnant woman see dead rat inside her soup wen she go eat dia early September.

On Tuesday, Hotpot restaurant Xiabu Xiabu stock fall to di lowest level for almost a year, afta foto show as dem dey remove dead rat with chopstick spread online.

Di restaurant been release statement on Saturday to say dem dey "rule out" di possibility say na lack of hygiene cause di rat to dey inside di hotpot, but dem delete di message.

Tori be say di restaurant bin offer di woman 5,000 yuan ($729) as compensation and dem don suspend dat particular branch for now.

Local tori pipo Kankan News wey speak to her husband Mr Ma, say di reason why im no gree collect di money na becos im want make im wife to do full body check-up before im go decide on di compensation amount.

Restaurant lose $190m sake of rat wey die inside soup

Wia dis foto come from, Other

Di pregnant woman wey been go out to chop hotpot with her family on 6 September, see di dead rat for her food afta she don already chop small inside.

Mr Ma dey claim say one of di staff been suggest to im wife to do abortion if she dey worry about di baby health, and even give am 20,000 yuan to do am.

Foto of di boiled rat full everywhere for Chinese social media site Weibo, many pipo vex chook mouth ontop di matter.

Hotpot restaurant Xiabu Xiabu

Wia dis foto come from, WEIBO

Wetin we call dis foto, Dem comot di dead rat from di plate

"I dey feel like say I wan vomit. I no go eva eat hotpot outside again," na wetin one pesin tok

On 11 September, di company share price drop to di lowest level since October last year. As of Wednesday di hotpot restaurant market value don dey recover small.

"Xiabu Xiabu na restaurant wey I like well-well, I feel dem dey clean too… I no fit believe dia kain thing," na wetin anoda pesin tok.

If something happun to her baby how dem go take compensate her? So now life dey worth 20,000 yuan?" na wetin one pesin ask.

Hotpot meal for China and across Asia

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Hotpot na correct food for China and across Asia

Authorities for Weifang city, di restaurant branch wey dem see di rat, say dem go investigate di matter for Xiabu Xiabu's restaurant.

Hotpot na correct food for China and even for some parts of Asia.