Yang Yang, Grumpy Cat and oda animals wey dia hustle pass your own

Wia dis foto come from, iStock
One Zoo for Vienna, Austria dey attract customers wit somtin wey dem neva see before, Panda wey sabi draw.
Yang Yang na woman Panda wey born twins two years ago, she don sabi use brush to paint small-small pictures and dey sell am online for $560.
Dem wan use di painting dem raise money to produce book about di Panda dem wey dey di zoo for Austria.
But Yang Yang no be di first or last animal wey dey hustle dey make money steady.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Grumpy cat
Many pipo go sabi Grumpy Cat. She popular well-well because of di way she dey keep her face and you fit don see her for meme sef.
Her owner, Tabatha Bundese, na server before and na her brother post one video of di cat for Reddit for September 2012. Di video go viral under 48 hours.
Since den, Bundesen don create company wia Grumpy don make like $100 million for shows, book deal and adverts.

Wia dis foto come from, Getty Images
Grumpy get ova 2 million followers for Instagram.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
Keiko di killer Whale
Na for 1979 dem capture Keiko for Reyðarfjörður, Iceland before dem begin sell am give aquarium and other amusement park.
For 1993 Keiko act inside di feem "Free Willy" where e make reach $36 million.
Even though dem decide to release am for 2002, she no make am.
Keiko die for Norway for 2003 at di age of 27.

Wia dis foto come from, Getty Images
Crystal the Monkey
Na $12,000 per episode of "Animal Practice" na im Crystal dey make.
Even though di feem only do nine episode, di monkey wey don dey show business reach 20 years now don act inside feem wey make reach $1.5 billion including "The Hangover Part II" and "Night at the Museum."














