Abuja building wey collapse na one storey wey owner change to five storey three months ago

Tori dey enta say one storey building don collapse for Abuja, central Nigeria and trap pipo inside.

Di five storey building wey collapse on Friday afternoon for Abuja don tanda for more than 10 year, according to wetin BBC News Pidgin find out.

Tori be say e suppose to be one storey building but like about three months ago dem begin build on top am.

Six pipo wey bin trap inside di building na im rescue workers don pull out as at 7pm Friday and five of dem dey collect treatment for Asokoro hospital and one die.

Di building fall for ground around 12 O'clock in di afternoon for Jabi district.

Nigeria acting Presido Yemi Osinjo and FCT minister rush go wia di building fall for ground inside di capital city for Nigeria.
Wetin we call dis foto, Nigeria acting Presido Yemi Osinjo and FCT minister rush go wia di building fall for ground inside di capital city for Nigeria.

Oga Prof. Osinbajo say e dey satisfied wit di wey di whole entire rescue operation waka and hope say those wey still dey trap under di building go come out alive

Umar Shuaibu of di Abuja Metropolitan Management council na im dey coordinate di rescue effort. Dem neva tok di official number of pipo wey trapp inside or pipo wey dem don save come outside from di building.

Tori be say at least one pesin die, five injure and many still dey trap inside, rescue officials don dey ground now to helep di victims.

Di five storey clollaps arround 12 O'clock for afternoon.
Wetin we call dis foto, Di five storey collapse around 12 O'clock Friday afternoon.
Site of building wey collapse for Abuja

E no too tey wey on 14 August, Council of Registered Builders of Nigeria (CORBON) and Standard Organisation of Nigeria (SON) do meeting to find how to take stop buildings wey dey collapse anyhow all over di kontri.

Site of building wey collapse for Abuja
Wetin we call dis foto, Rescue officials don dey ground to helep victims