You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
My landlord buy visitors' book for me - Single woman and rent palava
No be small wahala single women dey see for landlord dem hand for different parts of Nigeria.
Many women for different parts of Nigeria dey tok say to collect house as single woman dey very difficult sake of all di plenti different conditions wey landlords dey give dem.
Landlord wahahla dey make women do different kain tins like to present fake husband or boyfriend. Some dey go buy fake marriage certificate plus fake wedding ring to look like married woman.
Helena Nelson na media entrepreneur and actress, she say she don see plenti tins for landlord hand.