Lagos tanker fire: 'Pipo dey follow tanker do bumper to bumper'
Nigeria FRSC don confam say nine pipo die and 54 motor burn for di tanker explosion wey happen for Lagos-Ibadan express way.
Di Federal Road Safety Command (FRSC) Lagos state commander Hyginus Omeje confam wetin happun to BBC news Pidgin say, nine pipo burn sotey dem no fit recognise dem again.
Our tori pesin Dan Ikpoyi wey dey ground say, authorities dey try clear di area.