Plateau killing: VP Osinbajo confam say authorities don arrest some pipo

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria Vice President Yemi Osinbajo, confam say authorities don already arrest some pipo on top di Plateau State attack wey kill plenty pipo, including small pikin and women, for Barkin Ladi Local Government Area.
Professor Osinbajo say one Police oga and di Major-General of Operation Safe Haven Anthony Atolagbe don assure am say arrest don happun and dem go still arrest more pipo.
Im tok dis one during im sorry visit to di state wia im meet with Governor Simon Lalong, di community leaders of areas wey dey involve, and security officials dem.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Di recent attack leave almost 200 dead, according to unconfam reports, even though Police dey report say e no pass 86 pipo.

Wia dis foto come from, Chuwang Dalyop
Di VP also tok about money wey dem go use to from wan N10 billion fund wey President Muhammadu Buhari approve, to take assist farmers wey don lose dia business.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

Wia dis foto come from, Chuwang Dalyop







