Budget 2018: Presido Buhari belle no sweet wen im sign Nigeria 2018 spend money plan

Wia dis foto come from, TWITTER/NIGERIA PRESIDENCY
Nigeria Presido Muhammadu Buhari don sign di kontri 2018 spend money plan alias budget.
Presido Buhari sign 9.12 trillion Naira naira budget on Wednesday afternoon for Aso Rock Abuja.
' As e be so I dey concern about some of di changes wey National Assembly make on top di spend moni plan I give dem. Di logic wey make constitution allow Executive to prepare di spend moni plan, na say di Executive sabi & fit make policies & projects.' na wetin di Nigeria presido tok as im sign di budget.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, TWITTER/ NIGERIA PRESIDENCY
Di 2018 Budget wey di presido sign dey 22.6% higher dan di 2017 own.
Di presido say wetin im approve on Wednesday di Minister of Budget and National Planning go give details later.
Lawmakers approve di budget for May send am give Buhari six months afta di president bin submit di spend moni plan for December 2017.







