You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
‘How Abacha take die’
20 years don already waka pass since former Nigeria military ruler General Sani Abacha go meet im maker afta im die 8th June 1998.
Wetin really kill am? Goment doctor say na sumtin wey be like heart attack kill di military head of state.
But afta all dis years some pipo for Nigeria still no agree wit wetin di goment doctor tok.