Poor Nigerian pipo go get 5K per month from Abacha loot

Wia dis foto come from, FGN
- Author, Olu Okunnu
- Role, BBC News Pidgin
- Read am in 2 mins
5 million poor pipo for Nigeria go soon begin collect N5000 (dat na like $14) every month, as part of di National Social Safety Nets project (NASSP).
You fit wan know where di money wey dem go share give pipo go come from - part of am go come from $321m wey Switzerland don agree to release to Nigeria wey bi money wey family of former military ruler Sani Abacha bin thief keep for di kontri.
On 4 December 2017, Federal Government of Nigeria, Swiss Federal Council and World Bank sign Memorandum of Understanding (MOU) agreement to allow World Bank to monitor how Nigeria go collect and spend di money according to National Social Safety Nets projects (NASSNP).

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin be National Social Safety Nets Project
Dis na project wey World Bank dey help kontries organise for demsef so that pipo wey poor pass for di kontri no go continue to suffer without assistance.
Nigeria go get dia own NASSNP wey go help pipo wey poor pass for inside di kontri with money wey reach N5000 every month.
World Bank suppose make sure mago-mago no dey for di programme.
Rachid Benmessaoud, wey bi World Bank Country Director for Nigeria say: "wetin important pass now na to setup electronic national registry of poor families, with state-of-the art method to take target di pipo wey need am pass."
Where work don reach
National Social Safety-Nets Coordinating Office (NASSCO) go dey in charge of register wey go get di names of di pipo wey go collect dis money.
End of Di one wey oda users dey read well well
NASSCO follow BBC talk say, dia work start for 2016 and na about 17 states for Nigeria dem don go.
Even though dem never start to dey give pipo money, di register dey important because na pipo wey dia names dey inside go collect money.
Already registered states na Abia, Adamawa, Anambra, Benue, Borno, Gombe, Imo, Delta, Nasarawa, Katsina, Kaduna, Kano, Taraba and Jigawa.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
NASSCO say di way wey dem dey take know who need di money pass for community na through community leaders wey go come form joinbodi for men, women and youths dem.
Pipo for community go come decide who among dem poor pass.
Community go look things like pesin wey stay tey without work, pesin wey im husband don die tey and pesin wey get challenge wey fit make am no see work.










